[BIRTHDAY FLASH] Happy Ogbonge Birthday Greetings to a Pastor and Youth Leader wey Sabi

21 Oct, 2023

My community and contri pipo for Naija and in the Niger Delta, particularly the Ijaw pipo of Gbaramatu Kingdom for Warri South-West local government area, Delta State, and those wey dey other places, abeg make una join us to salute one fresh young pikin of Baba God wey today add another 24 months join the time dem born am.

This Ogbonge servant of Tamarau (Baba God) na him dem dey call PST. SAINT ABRAHAM B. A. TEBIANO, wey siddon yankata for the seat of two better association of God pipo for Gbaramatu, as: Secretary (person wey sabi write), Kunukunuma Christian Fellowship, KCF, Kunukunuma Town; and Secretary, Gbaramatu Interdenominational Christian Fellowship, GCFI.

Pst. Tebiano, we say congratulations as we salute you for the better work as servant of God wey you dey do and we dey encourage you make you nor match brake. We understand say as you climb mountain, our prayer be say make you continue to dey go up up, and make God carry you up up forever for this life we dey in Jesus name, Amen.

We also use this Birthday to congratulate you and your wife as Baba God just bless una by adding another new member to una family.

Una wey join to wish Pst. Tebiano Ogbonge Happy Birthday, na so God go comot yawa for una life and cause una to jollificate when una own day reach in Jesus name, Amen. 

Congratulations!

Courtesy:
Management
PENGlobal Inc.

#penglobalsocial #birthday

More Reads